Final results of Ghana election 2020: Nana Akufo-Addo win 2020 elections - Ghana Electoral Commission

 

Nana Akufo Addo

Nana Akufo-Addo of di New Patriotic Party don win di 2020 Ghana presidential elections, according to di kontri election office.

Di Ghana Electoral Commission announce Oga Akufo-Addo of di New Patriotic Party (NPP) as di winner, 48 hours after di 7 December election happen.

President Akufo-Addo win wit 51.59% wey represent 6,730,413 votes, according to di head of EC, Jean Mensa 

Di main opposition John Mahama of di National Democratic Congress get 6,214,889 votes wey bi 47.36%.

Madam Mensa wey serve as di returning officer, say di final results wey she announce no get that of di Techiman South constituency inside because collation never complete dia.

She even if dem add di total number of Techiman South voters wey bi 128,018, join di result of di second candidate, e no go change final position.

Over 17 million eligible voters participate for di election, wey many don describe as peaceful.

Di election na di first time wey Ghana go do electronic voting, something wey di EC chairperson say Ghanaians suppose dey proud of.

Jubilation don dey happen for di camp of NPP supporters across di kontri.

Akufo-Addo go return to serve im second straight term in office as president.

Comments